Small Pikin Enter Lion, Elephant Den, Come Out Alive After 5 Days

Small Pikin Enter Lion, Elephant Den, Come Out Alive After 5 Days
Small Pikin Enter Lion, Elephant Den, Come Out Alive After 5 Days


One 8-year-old boy for Zimbabwe don survive five days for Matusadona Game Park, wey lion and elephant dey live, according to one Member of Parliament, Mutsa Murombedzi.

Di tori start when Tinotenda Pudu waka go 23 km (14 miles) from him house enter di “dangerous” park. MP Murombedzi talk say di boy spend di five days “sleep for rocky place, hear lions dey roar, see elephants dey pass, and dey chop wild fruits.”

Matusadona Game Park na place wey about 40 lions dey live. Before-before, dem even get one of di highest lion populations for Africa, according to African Parks.

Di MP talk say Tinotenda use di bush sense and survival skills wey dem don teach am for him area to take survive. Di boy chop wild fruits and dig small wells for dry riverbeds with stick to find water.

Di Nyaminyami community people join hand begin search for am. Dem beat drum everyday make di sound guide am back, but na park rangers finally find di boy.

On di fifth day, Tinotenda hear one ranger motor sound and run towards am, but di motor nearly miss am. Luckily, di rangers see fresh small pikin footprint for ground and use am find am.

MP Murombedzi talk say di boy survival na miracle: “This na probably him last chance to survive after 5 days for wilderness.”

Matusadona Game Park dey big well well—about 1,470 square kilometers (570 square miles)—and na home to zebras, elephants, hippos, lions, and antelopes.

People for social media don dey hail di boy for him strong mind and survival skills. One person write say, “Dis one pass wetin human mind fit understand.” Another person tok say, “When he reach school, di tori wey him go get go mad o!”

Write a Comment