Osun King and Pastor Gree Say Dem Chop COVID-19 Money for America, Fit Land for Prison

The Apetu of Ipetumodu for Osun State, Oba Joseph Oloyede, and one Nigerian pastor, Edward Oluwasanmi, don admit say dem guilty for COVID-19 relief fraud matter for United States, and dem fit face serious prison sentence.
Oba Oloyede, wey before him become king for July 2019, dey work as accountant and information systems expert for US, and Oluwasanmi, dem arrest dem earlier this year because dem join hand collect $4.2 million COVID-19 palliative money by fraud.
Di two of dem face 13 different charges including conspiracy to do wire fraud, conspiracy to defraud, money laundering, and illegal money waka.
Dem carry dem go court before Justice Christopher Boyko for US District Court for Ohio.
News about Oloyede arrest first leak when pipo for Ipetumodu begin notice say him no dey show face for important traditional events. Later, Saturday PUNCH confirm say di king dey inside US custody.
Court papers show say between April 2020 and February 2022, Oloyede and Oluwasanmi use fake applications collect Paycheck Protection Programme (PPP) and Economic Injury Disaster Loans under di US Coronavirus Aid, Relief and Economic Security (CARES) Act.
Dem allegedly use fake tax papers and salary documents to chop money wey dem suppose use help small businesses wey COVID-19 affect.
Di CARES Act na program wey US government do to help small businesses and non-profits survive during di pandemic, including grants of up to $10,000 from Small Business Administration.
Before Oba Oloyede become king, he bin dey live for Medina, Ohio. Dem accuse am say he use him companies—Available Tax Services Incorporated, Available Financial Corporation, and Available Transportation Company—run di fraud.
Pastor Oluwasanmi sef allegedly use him own companies—Dayspring Transportation Limited, Dayspring Holding Incorporated, and Dayspring Property Incorporated—take collect millions illegally, and chop di money for personal enjoyment, against US federal law.
Altogether, dem talk say di two men carry about $3.76 million through the COVID-19 relief programs.
As dis matter don burst, some pipo for Ipetumodu dey beg Osun State Government make dem investigate the king well and take correct action.
Write a Comment