Native Doctors For Anambra Don Curse Soludo Say E No Go Win Second Term

Native Doctors For Anambra Don Curse Soludo Say E No Go Win Second Term
Native Doctors For Anambra Don Curse Soludo Say E No Go Win Second Term


Di fight between Anambra State govment and native doctors don hot as over 300 native doctors from different parts of di state gather yesterday to condemn Governor Chukwuma Soludo crackdown on dia activities.

As The Razor report am, di native doctors pray and swear say Soludo no go win di November 8, 2025 election for second term.

Dem gather for one secret place do prayers and rituals to fight back di governor “unjust interference” for dia matter.

Governor Soludo don start serious campaign against cultism and social vices, but di native doctors dey claim say di campaign dey target dia profession.

Di leader of di group, High Priest Ikele, call di governor action “unfair and discriminatory.”

“We no be cultists or criminals,” Ikele talk. “We be traditional healers wey don dey serve our communities for generations. Governor Soludo wan spoil our name and stop our work, but e no go succeed.”

Di native doctors vow say dem go continue dia prayers and rituals to protect dem from wetin dem call di governor “evil intentions” and to make sure e no win reelection.

Di state govment never reply dem, but people wey near di governor office talk say Soludo still stand gidigba for him anti-cultism campaign.

“Genuine native doctors no get anything to fear because dem still get freedom of worship and religion under Soludo govment,” di source add.

Write a Comment