Lagos Police Bust Baby Factory for Ijegun, Arrest 3 People
Police for Lagos don burst one baby factory wey dey Afurugbin area of Ijegun and arrest three people wey dey run am — Maryam Vincent, Ujunwa Ifeanyi and Orie Ruth.
According to wetin police talk, the suspects dey kidnap young girls and force dem to born pikin inside the baby factory.
During the raid, police rescue seven women and three children wey dem hold captive. The rescued women be Precious (24), Magdalene (25), Adaobi (23), Princess (22), Ifeanyi (25), Amaka (26), and the children be Destiny (7), Miracle (5), and Success (2).
Police spokesperson, Benjamin Hundeyin, yarn say: “On April 5, 2025 around 2pm, we receive correct information say one baby factory dey operate for Afurugbin, Ijegun. We quickly move our men go there.”
He continue: “As we reach the place, we arrest Maryam Vincent, Orie Ruth, and Ifeanyi Ujunwa. Dem later confess say dem kidnap all those people from different parts of Lagos to use dem for the baby factory business.”
The suspects dey under police custody as investigation still dey go on.


Write a Comment