Gunmen Kidnap 7 Farmers For Ondo, Demand ₦100 Million Ransom

Gunmen Kidnap 7 Farmers For Ondo, Demand ₦100 Million Ransom
Gunmen Kidnap 7 Farmers For Ondo, Demand ₦100 Million Ransom

 

No fewer than seven farmers don fall victim as unknown gunmen kidnap dem for Itaogbolu area of Akure North Local Government Area, Ondo State. Di kidnappers don already demand ₦100 million before dem go free di victims.

Di Ondo State Security Network Agency wey people sabi as Amotekun Corps confirm di incident on Monday.

According to di Amotekun Commander, Adetunji Adeleye, di farmers bin dey work for farm on Saturday when di gunmen carry dem go.

Adeleye yarn:

“I fit confirm say di matter happen. Our men don enter bush since and dem still dey there. I even go there yesterday (Sunday), and we dey hopeful say we go rescue dem soon.”

Di state police spokesperson, Olushola Ayanlade, also confirm di kidnap. Him talk say police don already launch rescue operation, but because di operation still dey go on, him no fit confirm di exact number of people wey dem carry.

Ayanlade add:

“Yes, kidnapping happen for Itaogbolu during weekend, and police don start operation to catch who dey responsible. We dey work seriously to make sure dem bring dem back safe.”

Family sources talk say di kidnappers call on Sunday evening come demand ₦100 million ransom.

One source wey no want make dem call hin name talk say:

“Dem dey farm dey harvest palm fruit when di kidnappers attack. We no hear from dem again until Sunday evening when di kidnappers contact one family member.”

Negotiation between di families and di kidnappers still dey go on as at di time dem dey report di story.

Write a Comment