Daycare Owner Don Land for Cell After Her Dogs Kill 2-Year-Old Pikin While She Dey Sleep

One woman wey dey run illegal daycare for Georgia don land for serious wahala after her two big Rottweiler dogs k¡ll one 2-year-old pikin wey dem put for her care — all this happen while she dey sleep for hours.
The small boy, Kaimir Jones, na the only pikin wey dey the house that day. According to Valdosta Police Department, dem find the boy d€ad for the backyard of 48-year-old Stacy Wheeler Cobb by around 3:45 p.m. on Saturday.
Police talk say di boy waka comot from inside house while Cobb dey sleep, then mistakenly open the dog cage wey hold the two dangerous Rottweilers. As the dogs come out, dem attack the pikin wey no fit defend himself.
Cobb talk say she bin believe say the pikin dey okay as she go nap for over two hours. But the sad truth wey come out na say the boy don die before she even wake up.
Police also reveal say Cobb dey run the daycare illegally, and say sometimes she dey take care of up to 10 children at once without any proper license.
According to the Valdosta Police Chief, Leslie Manahan, this tragedy na pure case of negligence.
“This na horrible and sad event wey suppose no happen at all. Because of the caretaker’s carelessness, one mama don lose her pikin. We dey send our deepest sympathy give the family,” the Chief talk.
“Nothing fit remove the pain wey dem dey feel now. Our heart dey with them and even our first responders wey witness this kind tragic scene.”
Cobb don collect charge for second-degree murd£r and cruelty to children. The Rottweilers plus another dog wey dem see for the house, don dey Lowndes County Animal Control custody now.
Kaimir’s mama, Adrianna Jones, talk say her intuition push her to leave work early go check on her son, since she no hear from Cobb for hours. Wetin she see when she reach, na something wey she say she no go ever forget.
“This experience break my heart. Na trauma I no wish for even my worst enemy. I find my baby like that,” she write for GoFundMe page.
She also mention say Cobb get plenty good recommendation before she carry her pikin go leave for there.
As the case dey ongoing, authorities don promise say justice go follow for this painful matter wey don shock the whole community.
Write a Comment