Celebration Turn Wahala As Retired Headmistress Bello Dupe Collapse, Die for Her Retirement Party

Wetin suppose be happy day turn sad moment for the family of retired headmistress, Madam Bello Dupe Omowumi, as she collapse kpai during her own retirement ceremony.
Di gbege happen on Wednesday, April 9, 2025, for School for the Physically Challenged, Enu Odi, Ilesa, Osun State.
According to tori wey dey go round, Madam Bello — wey her colleagues and students describe as serious and committed woman — just finish long years of work for education. Di party na to celebrate her service, but e turn to tears and sorrow.
Dem talk say she just recently step down from her position as headmistress for the school where she serve with all her heart.
Wey she reach the venue, people say she dey happy, dey smile and dance enter the hall with drummers dey follow her.
“She dey smile, dey dance. Everybody happy,” one teacher talk.
“But nobody expect wetin happen next.”
After dem don escort her go high table with her husband, na there she begin show signs say body no dey balance.
“She look tired, like say she dey struggle breathe,” one guest yarn.
People rush come help, give her first aid, but as e no work, dem carry her go Ijesaland Geriatric Centre. From there, dem refer her to Wesley Guild Hospital for Ilesa, but unfortunately, doctors pronounce her dead on arrival.
As news of her death spread, di whole place quiet — shock catch everybody. Tears replace dance for di hall wey suppose be full of joy.
Write a Comment