“You Wan Rescue Your Belle”….Wike Attack Atiku, Obi, Others

Minister wey dey in charge of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, don open fire for Atiku Abubakar, Peter Obi and other leaders wey dey the opposition coalition. Him talk say dem no really wan help Nigerians, na demself dem dey fight for.
Wike yarn this one for thanksgiving service wey happen on Sunday for Abuja, after dem finish some projects for FCT.
Him talk say:
“How Nigerians no go vex for una? Since 1999 you dey one party, 2006 you move go another one, 2014 you waka again, 2019 you come back, now 2025 you don jump enter another party. Who you wan rescue? No be Nigerians o – na your belle you wan rescue.”
“You dey support person wey you no sabi. You dey shout ‘Peter Obi go be president’. President how? Him be governor for 8 years, e no do local government election once. Na so democracy be? Na only am be governor and chairman at the same time.”
Wike no stop there, him continue:
“Make una reason am. Say I be Senate President for 8 years, and I no fit do one small road go my village – Otukpo. Na helicopter I dey fly go there. Now na me dey talk say I wan rescue Nigeria? Which Nigeria I wan rescue?”
“Another one be Speaker 8 years, Governor 8 years, Minister 8 years. All the time e no know say Nigerians dey vex. Na now e come talk say people dey suffer. Why dem no go vex?”
“Transportation Minister for 8 years, borrow borrow full ground. Nigeria dey owe China like say tomorrow no dey. Now una dey say Nigerians dey angry – dem dey angry with una!”
“You be Attorney General for 8 years, na so so judgment debt Nigeria dey pay. Country name no dey comot for corruption news. You come dey shout rescue – rescue who?”
“You even be Minister of Interior, but to get ordinary international passport na wahala. People go wait months. But look young boy now – within hours passport go drop. Why you no fix am when you dey office?”
Wike come beg church people make dem calm down and support President Tinubu:
“I beg the church, make una dey patient. Make una dey pray for Mr. President and this government. Forget people wey don fail when dem get chance to fix Nigeria. Their own don finish.”
“Dem no sabi stay without power. But e don happen – dem no go come back.”
This opposition group wey dey make noise with African Democratic Congress (ADC) na dem Atiku, Peter Obi, Rauf Aregbesola, Nasir El-Rufai, and David Mark. Dem dey plan for 2027 election.
Write a Comment