Wahala for Church as Man Confess Say Pastor Pay Am ₦10,000 to Fake Deliverance for Lagos
Gbéké don burst for one church for Lagos afta one man wey call himself Chinedu confess say na the pastor pay am to fake deliverance.
Di drama happen afta Sunday service wen Chinedu tell one of our reporters say di pastor give am ₦10,000 make e act like say e dey possessed by evil spirit, and den pretend say di pastor deliver am.
According to Chinedu, di pastor promise am more money if e continue dey act the drama well so that new members go believe say real miracle dey happen for di church.
Di confession scatter everywhere as many church members begin cry, shout and ask questions. Some people talk say dem don already dey suspect say all the so-called miracles na audio, while others just sit down for chair dey look pastor with wide eye.
One mama wey no gree mention her name talk say: “I don dey bring my children come this church since last year. So all those shouting and falling na acting? God go judge.”
As of press time, di pastor never talk anything, and security people for the area don dey try calm tension as the matter dey hot like fire.
Na so we see am for Lagos this Sunday.


Write a Comment