Senator Natasha Husband Stand By Her Side Over Akpabio Matter
Emmanuel Oritsejolomi Uduaghan, wey be husband of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan, don defend him wife after she talk say Senate President Godswill Akpabio make inappropriate moves towards her.
For Friday, during one interview for Arise TV, Natasha, wey dey represent Kogi Central, talk say Akpabio don try toast her both for him office and for him house for Akwa Ibom. Dis one happen after dem get small wahala for Senate over seating arrangement.
On Saturday, Uduaghan, wey be Alema of Warri Kingdom, release statement say him wife don already gist am about wetin happen between her and Akpabio.
“I personally go meet Senate President, come beg am make e respect my wife well, and also respect the friendship wey dey between us. We reason the matter and agree say we go settle am peacefully,” Uduaghan talk.
“But even after we talk that one, my wife still dey complain say she dey face harassment from Senate President. I believe my wife well well, and I stand with her fully because our marriage dey built on love, respect, and trust.
I no go ever trade my wife for anything because she be my greatest joy. So, I dey beg the Nigerian Senate and Senate President make dem give my wife the respect wey she deserve, while the authorities and court go handle the matter,” Uduaghan talk.


Write a Comment