Prof Pat Utomi Talk Say Tinubu “Beast” Na Car Wey Nigerians No Suppose See

Prof Pat Utomi Talk Say Tinubu “Beast” Na Car Wey Nigerians No Suppose See
Prof Pat Utomi Talk Say Tinubu “Beast” Na Car Wey Nigerians No Suppose See

Nigerian political economy professor, Pat Utomi, don yarn say President Bola Tinubu official car, wey dem dey call the Beast, na kind car wey nobody wey dey live for Nigeria suppose even see.

 

For interview wey he give Atlanta Discuss Channel, Prof Utomi talk say Nigerian roads no even fit carry that kain heavy car. He add say e dey worrying say government go spend that kain money buy expensive vehicle for country wey basic infrastructure still dey suffer. Utomi yan say the car cost about one billion naira.

 

According to Prof Utomi:

“Bola Tinubu even buy this ‘Beast’. Nobody wey dey live for Nigeria suppose see that kain vehicle because Nigerian roads no even dey fit am. But just to show power, I guess he pay one billion naira for the kain ride wey American president dey roll out. All these things dey show clearly where wahala dey for Nigeria in terms of how people wey dey in leadership dey reason.”

 

Prof Utomi opinion dey raise questions about priorities and leadership consciousness for Nigeria.

Write a Comment