Presidency Warn Amaechi Make E No Dey Talk “Waka Talk” As 2027 Election Dey Come

Presidency Warn Amaechi Make E No Dey Talk “Waka Talk” As 2027 Election Dey Come
Presidency Warn Amaechi Make E No Dey Talk “Waka Talk” As 2027 Election Dey Come

 

As people don begin warm up for di 2027 general election, Presidency don send strong warning to former Rivers State Governor and ex-Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, make e no dey talk anyhow or dey twist history just to score political point.

 

Olusegun Dada, wey be Special Assistant to President Bola Ahmed Tinubu on Social Media, na him deliver di message. E talk say Amaechi suppose “stay for inside truth” and stop to dey make “bizarre and outlandish claims” wey no get head or tail.

 

Dis warning follow reports wey dey fly say Amaechi dey part of one new political gang wey wan form anti-Tinubu coalition, with aim to remove Tinubu come 2027.

 

But Dada no even shake. E talk say all dis coalition matter no go reach anywhere, and say dem no get level to carry Tinubu comot for office through election.

 

As Nigeria dey mark two years under Tinubu government, Dada come talk say despite wahala wey dey ground, di administration still dey “follow correct road to success.” E say President Tinubu still dey focus on wetin e promise Nigerians, and dem no go allow any political distraction shift their eyes from di goal.

 

Di presidency don make am clear say dem ready face anybody wey wan bend story or spread talk wey no follow, especially as election matter dey come close.

Write a Comment