No Be Side Hustle! – UI Warn Female Students About Egg Donation

No Be Side Hustle! – UI Warn Female Students About Egg Donation
No Be Side Hustle! – UI Warn Female Students About Egg Donation

 

University of Ibadan don raise alarm say many female students don dey use egg donation take hustle money, and dem no dey happy with the trend.

 

For memo wey come out April 15, 2025, wey PUNCH Online see on Friday, University Health Service warn say even though egg donation dey help families wey dey find pikin, e no suppose turn to regular way to make money or be side hustle.

 

Di memo na from Director of University Health Service, Dr. Aderonke Ajayi, wey say di matter don dey increase for inside UI community. She talk say many girls dey recruited by agents or middlemen to donate eggs for IVF (In-Vitro Fertilisation).

 

She explain say di egg donation process no be beans — e involve hormone injection to make ovaries produce eggs, and that one fit cause plenty health wahala.

 

Some of di risk wey she mention include:

• Belle pain

• Breast wey dey pain

• Body bloating

• Mood wahala

• Ovarian Hyperstimulation Syndrome (OHSS)

• Infection, bleeding, and even damage to organs like bladder and intestine

• Mental stress join

 

She come still talk say some people wey don donate eggs before don complain say e affect their fertility later. Research still dey go on about how many times person fit donate egg safely.

 

She warn say no be more than three times per year person suppose do egg donation, and students suppose always go legit clinics wey dey follow medical guidelines well and put donor health first.

 

Di memo end with strong advice:

 

“Make una put una health first before money. No allow anybody deceive or use una body anyhow. Egg donation no be shortcut to chop life.”

 

University come beg everybody for campus make dem help spread di message, so say female students no go fall victim to exploitation or ignorance.

Write a Comment