Nigerian Navy Sack Officer Wey Sleep With Colleague Wife, Give Am 3 Years Jail

The Nigerian Navy don sack one of dia officer, a Lieutenant, because say e enta scandalous relationship with another officer wife. Di Navy say di man go also serve three years for prison as punishment for di same wahala.
Tori wey reach our hand from Naval Headquarters for Abuja confirm say di Special Court Martial (SCM) wey handle di matter don find di Lieutenant guilty of di offense.
“The SCM, after dem finish di hearing, find di officer guilty as charged. So dem give am three years imprisonment plus dismissal from Nigerian Navy. Di punishment don start since 23rd November 2024,” one source talk.
Di Navy no take di mata play, as dem see am as disgraceful and against di discipline wey military suppose stand for. Sources talk say di Navy believe say wetin di officer do fit spoil morale and trust among personnel if dem no handle am well.
As e be so, di Lieutenant no be Navy person again, and e go spend di next three years for detention as ordered by di court.
Di Nigerian Navy don use dis example take show say dem no go tolerate any act of misconduct or indiscipline, especially when e concern moral and ethical behaviour.
Write a Comment