New Super Eagles Coach, Eric Chelle Go Collect $55,000 Monthly

New Super Eagles Coach, Eric Chelle Go Collect $55,000 Monthly
New Super Eagles Coach, Eric Chelle Go Collect $55,000 Monthly

 

Naija Football Federation (NFF) don announce say dia new coach, Eric Chelle, go dey collect $55,000 every month as salary. Dat one translate to N84,984,900.00.

Chelle, wey be former Malian coach, go arrive Naija on Saturday with two of him assistants, and dem go unveil am for Abuja on Monday.

Him two assistants go dey collect $5,000 every month, while Chelle go dey pocket $50,000.

Chelle go start work immediately, as him go dey in charge of Super Eagles B team wey go compete for CHAN 2025 for Morocco. CHAN go start from February 1, 2025.

Him major work na to qualify Super Eagles for 2028 FIFA World Cup.

Write a Comment