Natasha Leak 2Face & Annie Separation, Management Rush Cover Up
On Sunday, 26th January 2025, Natasha dey with 2Face and some friends. As 2Face dey sleep, Natasha carry him phone go post for Instagram, announce say 2Face and Annie don separate. Meanwhile, dem don keep dis matter private for almost one year now.
After she post am, some of 2Face celebrity friends begin call him phone. Na so e take wake up from him nap. Him management sef call am, come tell am say dem see the post. 2Face tell dem make dem delete am sharp-sharp, say him no wan make e go public yet. E still talk say him no wan make family matter scatter everywhere, especially as people don dey blame am for Annie condition wey don dey affect him new song promotion.
Him management quick quick pull down the post come talk say na hackers do am, just to cover the wahala wey Natasha cause.
But Natasha vex say dem delete the post. She come threaten say if 2Face no do video confirm say dem don separate, she go abort her pregnancy, quit the relationship, and move on. The truth be say, 2Face and Annie really don dey head for divorce.


Write a Comment