Naija Woman Wey Dey Live for UK Don Lose Custody of Baby Wey She Carry Enter Country

Naija Woman Wey Dey Live for UK Don Lose Custody of Baby Wey She Carry Enter Country
Naija Woman Wey Dey Live for UK Don Lose Custody of Baby Wey She Carry Enter Country


One Nigerian woman wey dem call Susan wey dey live for West Yorkshire don lose custody of one baby wey she carry enter UK, after British Family Court talk say she no get any blood connection with di pikin and e be like say she fit carry di baby through illegal way.

Dem arrest Susan for Gatwick Airport for July 2024 as she land from Nigeria with one newborn baby girl wey dem call Eleanor.

Before she travel, Susan don tell her doctor say she dey pregnant. But when dem check am, test show say she no dey carry belle. Instead, dem find tumour for her body wey she no gree treat. Susan come talk say her belle no dey show for scan, say “my babies dey always hide,” na wetin BBC report.

She travel go Nigeria for June, and later tell UK doctors say na there she born di baby.

But when she come back with the baby, police and social workers enter di matter.

DNA test later show say neither Susan nor her husband get any blood relation with di pikin.

When dem ask her, Susan talk say na IVF she use take get Eleanor—say na donor egg and sperm she use before she come UK for 2023.

She even bring paper and photos to back her talk, but one expert social worker wey dem call Henrietta Coker check am well and talk say di document dem be fake.

Di clinic wey she claim say do di IVF no even get her record. Di hospital wey she talk say she born for, na just one anyhow house wey small small boys wey wear nurse cloth dey run.

Even di doctor wey sign di birth paper come talk say na true say person born there, but no be Susan.

Di matter come worse when dem check Susan phone and see message wey she send give one contact wey she save as “Mum oft Lagos Baby.” She dey ask for hospital things, and di reply come list price for “delivery drugs” and “hospital bill” — e be like say dem dey arrange baby transaction.

Judge Recorder William Tyler KC talk say Susan and her husband cook up fake story about Eleanor birth, carry fake paper come, and don cause plenty emotional and mental wahala to di pikin.

Di judge order say make dem carry Eleanor go adoption, and he give official statement say Susan no be di pikin mama.

Social worker Vikki Horspool wey dey represent di baby side talk say Susan and her husband still dey lie about where di baby come from.

Even though Susan lawyer beg make dem return di baby, di court no gree — dem don rule say adoption na di final step.

Write a Comment