My Wife Dey Send Her Nude Pictures A Man- Gospel Musician Explains Why He Divorced Him Wife
My Wife Dey Send Her Nudes to Other Men – Gospel Singer Paul Nwokocha Explain Why E Divorce Second Wife
Veteran gospel singer, Paul Nwokocha, don open up about wetin make e second marriage with Goodness scatter after just one year.
E talk say e catch him wife dey snap nude pictures and dey send give other men. Na why e no fit continue the marriage again.
For one post wey e drop for Instagram on Sunday night, Nwokocha talk say:
“I marry wife, no be ashawo, so I no owe anybody apology for this. Stop to dey call me names. Na who wear shoe know where e dey pain am. No matter how long I don marry you, if I see say you dey do bad thing, na out you go from my house.”
E don clear now say na serious matter cause the breakup, and the singer no wan make people judge am anyhow.


Write a Comment