“My Spirit Don Leave Government House “…Fubara

“My Spirit Don Leave Government House “…Fubara
“My Spirit Don Leave Government House “…Fubara

 

Suspended Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don talk say e no dey in any hurry to go back Government House, say him mind don already comot from there tey-tey.

 

Fubara talk this one on Sunday for Port Harcourt during Night of Tributes for late elder statesman, Chief Edwin Kiagbodo Clark. Na him first public appearance since President Bola Tinubu suspend am and declare state of emergency for Rivers on 18 March, 2025.

 

According to am, he no come the event for politics, but to honour Pa Clark wey stand for am and sacrifice plenty.

 

“If to say na my power, I for no return,” Fubara yarn. “But people like Pa Clark don pay price for my sake. I no fit disappoint dem.”

 

As some speakers begin fire political shots during the tribute night, Fubara caution say make dem no turn the remembrance to political fight against him predecessor, Nyesom Wike, or President Tinubu.

 

He talk say sometimes silence dey better: “No be every fight person suppose fight. If wetin dey happen no match wetin dey my heart, I go just keep quiet.”

 

The suspended governor also talk say since he comot office, him mind don calm, and he beg him supporters make dem no dey talk anyhow wey fit scatter the state more.

 

“Make una check una ways — this your style, e dey help peace or e dey scatter am?” he ask. He still pledge say he go dey law-abiding and do everything to bring peace back to Rivers State.

Write a Comment