Man Faint After Him Hear Say Him Wife Born Triplets for Kogi

Man Faint After Him Hear Say Him Wife Born Triplets for Kogi
Man Faint After Him Hear Say Him Wife Born Triplets for Kogi

 

One man wey dem call Adamu Muhammed Tenimu faint for Lokoja, Kogi State, after dem tell am say him wife don born triplets.

 

The wahala happen for Federal University Teaching Hospital, Lokoja, on Friday, May 30, 2025. According to people wey dey there, as dem tell Adamu the tori say na three pikin him wife carry born, the man just slump for ground — emotion too much for him body.

 

Nurses, doctors and people wey gather quickly help am regain him sense back. Meanwhile, mama and the triplets dey stable condition for hospital.

 

After Adamu regain consciousness, him talk say even though he dey thank God for the miracle, he still dey confused and worried. “I no know say na triplets we dey expect. We no even get money to pay hospital bill talk less of to take care of three babies at once,” he talk with tears for him eye.

 

Adamu still talk say na only one baby dem prepare for, because dem no fit do scan often as money no dey.

 

“This blessing big, but the burden sef big. I no even get money to buy pampers or baby food. I dey lost,” he cry.

 

People wey see wetin happen talk say even though the babies strong and healthy, the family need urgent help — from medical supply to food and money.

 

One family member yarn say, “Na God do am, but dem need help seriously. We dey beg government, NGOs, churches, mosques and good Nigerians to help this family.”

 

Friends and neighbours don start mobilize support for the family, say make everybody do small wey dem fit.

 

Mr. Nuhu Alhassan, wey be colleague of the papa, add say, “The man na good person. He dey try, but this one pass am. Make Kogi State Government and Ministry of Women Affairs help this family now.”

Write a Comment