Kogi State University Lecturer Die for Hotel Room After ‘Doing’ With Student

One senior lecturer for Kogi State University, Anyigba — Dr. Olabode Abimbola Ibikunle — don kpai for hotel room under wahala circumstances after e knack one 22-year-old 200-level student.
Di matter happen on Tuesday, July 15, and dem report am give police by the next day. Tori wey reach ground talk say the lecturer, wey don marry and wey people sabi as strict for class plus say e dey always chase female students for corner, carry one student from Department of Social Studies Education go lodge for one hotel.
People wey see wetin happen talk say Dr. Ibikunle drink plenti energy drink before dem begin the “match.” But na during the match e just slump. Dem rush am go hospital but doctor talk say the man don already kpai.
Kogi State Police Command PRO, SP William Ovye Aya, confirm say na true the matter be. E talk for interview with SaharaReporters say dem don carry the student, wey her name na Gloria Samuel, into custody to investigate more.
Na so Aya take talk:
“The hotel manager, Moses Friday, come Anyigba Police Station come report say one guest collapse after him and student do. The DPO run go the hotel, carry the man go hospital, but doctor talk say the man don die.”
Dem don carry Gloria go State Criminal Investigation Department (SCID) for Lokoja for proper investigation. Dem don do autopsy for the lecturer body, but dem never release the result.
This sad matter don shake the university community as many people don dey talk about lecturers wey dey misuse their power to collect s*x from students. Plenty students and staff don dey call for better monitoring and discipline for the system.
Write a Comment