Kano Gov Sack Two Senior Aides Over Bad Behaviour

Governor Abba Kabir Yusuf of Kano State don sack two of im Senior Special Assistants (SSA) after government investigation committee find dem guilty of serious misconduct.
Di first person, Abubakar Umar Sharada, wey be SSA on Political Mobilisation, lose im job after committee confirm say na im masterminded di controversial bail of one well-known drug baron, Sulaiman Aminu Danwawu. Sharada even talk for him own mouth during di hearing say he follow arrange di bail process.
For statement wey Secretary to di State Government, Alhaji Umar Farouk Ibrahim, release on Saturday, di governor order say Sharada must return all government property wey dey him hand to di Permanent Secretary, Research, Evaluation and Political Affairs, before close of work Monday, 11 August 2025. Dem also warn am make e no dey pose as government officer again.
Di second person, Tasiu Adamu Al’amin Roba, SSA for Cabinet Office, dem sack am because police catch am for 2024 rebagging palliative grains for Sharada warehouse. Dem don carry am go court for theft and criminal conspiracy.
Meanwhile, di government clear Hon. Musa Ado Tsamiya, Special Adviser on Drainages, say e no get any case to answer.
Governor Yusuf talk again say im government no go gree for corruption or misconduct from public officers.
Write a Comment