Ibom Air Wahala: Comfort Emmanson Don Open Mouth Talk Her Own Side of the Story

lComfort Emmanson, the passenger wey get gbege with one Ibom Air flight attendant some days ago, don finally talk her own side of wetin really happen. According to her, she talk say the air hostess beat her, disgrace her and even scatter her things during the flight.
As she take yarn for her Instagram handle @soft_commy on Sunday night, she talk say the air hostess wey her name be Julian Edwards tear her wig commot for head, cut her gold jewellery and spoil her mobile phones join.
She say the whole wahala start when she dey struggle to off her phone during the pre-flight announcement. But as dem land for Lagos, the whole matter come turn serious palava.
She still talk say the flight attendant insult her anyhow, even call her ashawo for inside the plane. Later, she say the same woman block her make she no fit come down from the plane, and even beat her wey give her bruises for body.
She talk say:
“First, I wan thank God Almighty and everybody wey stand by me and fight for me that time dem carry me go prison. When I come out, the love and support wey I see shock me. I no even expect am as I be ordinary person. God go bless una.”
She continue:
“Na on August 10 I enter flight from Uyo to Lagos. As dem dey do normal procedure, the lady Juliana dey go round tell people make dem off their phones. When she reach my side, I dey struggle with my phone.
I tell her say the power button for one of my phones no dey work. She come talk say I fit off am from Settings. I get two phones. The man wey dey sit near me help me off the second one.
As I dey try explain to her, she no gree hear. I even beg her make she help me off am, she say ‘children of nowadays’—that one pain me well.
Next thing, the woman just dey para for me. She tear my wig for my head, cut my gold chain, spoil my phone and even dey call me ashawo.
Wetin I do to deserve all this? The pain too much. Dem even video me, post am online. My body don dey everywhere now, people don dey use my clip do sticker.”
“I dey into real estate. Now I dey fear go interview or go meet client. Wetin if person wey wan buy land see me finish? My breast don dey internet, na shame I dey carry now. I never talk my side of the story before because I still dey recover.”
“I no believe say na just because of phone wey I no off quick, the matter go reach like this. Now people dey laugh me, dey send me message say my body dey everywhere.”
“Those wey sabi me know say I no too like social media. But I thank God say I don strong enough to talk now. I no be wahala person, I no be nuisance. I no ever refuse to off my phone. Na just say the button no dey work and I dey try explain.”
Write a Comment