“I no believe say anybody wey dey this church go do mumu again this time” – Pastor David Oyedepo

“I no believe say anybody wey dey this church go do mumu again this time” – Pastor David Oyedepo
“I no believe say anybody wey dey this church go do mumu again this time” – Pastor David Oyedepo

Popular man of God, Bishop David Oyedepo, don send strong message give im church members as 2027 general election dey come. E beg dem make dem use sense and wisdom take vote this time.

As e dey preach for one recent church service, the Living Faith Church (Winners Chapel) founder talk say people suppose vote with correct information, no be just anyhow.

E come talk say:

“The money wey dem give una for last election, e still dey? I no believe say anybody for this church go do mumu again this time. Today na Muslim-Muslim ticket dem dey push, tomorrow na Fulani-Fulani, next tomorrow na governors dey hand over power to their brothers. All because dem don scatter federal character for this country…”

Pastor Oyedepo still vex say people just dey sell their votes anyhow, and e no make sense again as the country dey go down because of bad leadership and tribal wahala.

 

Im message clear: make everybody wise up for 2027, no sell your vote, and no let anybody use you play.

Write a Comment