“Go Beg Trump”…..Adeboye Tells Tinubu

“Go Beg Trump”…..Adeboye Tells Tinubu
“Go Beg Trump”…..Adeboye Tells Tinubu

The General Overseer of Redeemed Christian Church of God (RCCG), Pastor E.A. Adeboye, don advise President Bola Tinubu make e beg US President Trump to give am 100 days to stop all di killings wey dey happen for Nigeria. Pastor Adeboye talk this one for Friday evening during di November edition of Holy Ghost Night.

 

Pastor Adeboye talk say once Tinubu go plead make Trump give am 100 days, e suppose immediately direct Service Chiefs and other security heads make dem end di killings within 90 days. If dem fail, dem supposed resign.

 

Di cleric also yan say e dey only talk to RCCG members now as e dey wait make Christian Association of Nigeria (CAN) yan for all Christians matter.

 

He remember say e don give similar advice to late President Buhari, but Buhari no follow am.

 

Adeboye talk say,

“I sure say una don hear dis kind talk before. One president, Buhari, don get similar order. Na so e take run di advice, but e no follow am complete. Di security operatives try move, but after three months, di work no finish.”

Write a Comment