From Role Model to Romance Scammer: Physically Challenged Shoemaker, Timi, Busted for Catfishing Men Online”

Wetin suppose be inspiration don turn serious disgrace as one popular shoemaker for social media, Timilehin Oyedele Godwin, aka Timi, don land for police wahala after dem catch am impersonate woman to scam men online.
Timi wey gain fame in 2023 as a physically challenged hustler wey dey find wife, don shock everybody with the kind fraud wey dem accuse am of.
According to reports, one lady named Oluwadamilola Oluwasheteminire raise alarm say Timi dey use her face and pictures take deceive men online. She say Timi steal her identity and use am to create fake pages for:
• TikTok
• And even WhatsApp
Na since 2022 he allegedly start the scam — creating accounts like:
• @Damilolag279 on TikTok
• Adebola Gloria on Facebook
• And use WhatsApp number 07081811101
Dem say he even download nudes from Google and send give men to make dem believe say na the real babe dem dey chat with.
Timi no deny am. For a video wey he record on 23rd September 2025, he confess everything:
“I made a video about catfishing and doing replica pages of Oluwadamilola… I use her pictures clone accounts… use WhatsApp to chat people and exchange nudes. I am very sorry for all my actions. I apologise to Oluwadamilola and everybody wey I mislead.”
He talk say when one person confront am before, he try brush am off as “old matter”, but now he don fully accept say he mess up.
After his confession, Timi don reportedly chop rearrest again, and dem force am to do public apology. Meanwhile, police say investigation still dey go on concerning all the online activities wey e do.
Nigerians don para for online:
“I’m so disappointed . I don even patronise am before for my man… now see wetin I dey hear. Shame!”
“This one na serial catfish! Why e never go prison? Abi na because say e get disability, dem dey pity am?”
“This guy don dey show signs since secondary school. I hoped people for forgive am before, but the matter don get k-leg. He need serious mental help.”
Many people dey wonder how Timi wey inspire plenty people with him hustle story turn around use people trust against them. Some say na abuse of sympathy, others dey beg make people no use the case generalize all physically challenged people.
But one thing sure be say — catfishing no be hustle, and sympathy no be immunity from justice.
Write a Comment