Former Access Bank Worker Accuse Say E Dey Record Him Colleagues for Toilet

Dem don accuse one former Quality Assurance Specialist for Access Bank Contact Centre for Oniru, Lagos — Stephen Ifeanyichukwu Ejezie — say e dey secretly record him colleagues anytime dem enter restroom.
According to wetin Foundation For Investigative Journalism (FIJ) report, dem catch Ejezie for inside the women restroom around 1:30 a.m. on Wednesday. After dem catch am, Access Bank come order make dem arrest am. When police go search him house, dem find hundreds of k-leg videos.
Even after all these kasala, dem don release Ejezie, and e dey make some staff dey fear say dem no go see justice.
FIJ talk say Ejezie LinkedIn profile still show say e dey work for Access Bank as of Friday morning, but by afternoon e don update am say e no dey with the bank again. According to him profile, e start work as Contact Centre Agent for February 2023, and by October dem promote am to Quality Assurance Specialist.
Some people wey sabi the matter talk say the contact centre dey run shift work, and many staff dey sleep, bath and change cloth for office. Na during one of these shifts, Ejezie allegedly waka go women restroom to fix hidden camera.
One female staff catch the thing when she see phone wey dey point towards her from the next toilet cubicle as she dey bath. She shout, and other staff rush come, na so dem catch Ejezie inside the toilet.
FIJ also find out say Ejezie get plenty videos of both male and female staff wey no wear cloth. When police search him house, dem see more than 400 videos for him laptop.
Tori still talk say Ejezie dey sell the videos online through platforms like OnlyFans and Telegram, and some oyibo people dey buy am.
Despite how serious the wahala be, dem release Ejezie and Access Bank management never really talk about the matter well, wey don make people dey suspect say dem wan cover the case to protect the bank name.
Plenty staff wey dem interview talk say dem fear because many people no even know say dem don record them, and dem dey worry about how the videos fit leak later.
For one meeting wey management do on Friday morning, dem tell staff say make nobody sleep for office again, and if dem break the rule, na heavy wahala e go bring.
But workers dey vex, say the measures no reach. Dem accuse management say dem care more about their company image than the staff wey don suffer.
One staff talk say, “We dey traumatized, and dem never give us any support. People suppose know whether dem record them, make e no go haunt dem later.”
FIJ try reach Access Bank for comment, but up till press time, the bank never talk anything.
Write a Comment