EFCC Don Arrest Former Top NNPCL Officials Over Alleged $7.2 Billion Refinery Fraud

EFCC Don Arrest Former Top NNPCL Officials Over Alleged $7.2 Billion Refinery Fraud
EFCC Don Arrest Former Top NNPCL Officials Over Alleged $7.2 Billion Refinery Fraud

 

The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arrest some former big men wey work for Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) over alleged $7.2 billion fraud wey concern the failed plan to repair Nigeria refineries.

 

Among the people wey EFCC don carry na Umar Isa, wey be former Chief Financial Officer (CFO) for NNPCL. During him time, na him supervise the release of plenty money for the so-called turnaround maintenance of Kaduna, Warri, and Port Harcourt refineries.

 

Another person wey dem arrest na Jimoh Olasunkanmi, wey be former Managing Director of Warri Refinery.

 

EFCC talk say dem dey investigate these officials for things like:

– Abuse of office

– Corruption

– Diversion of public funds

– Collecting kickbacks from contractors

 

Dem say the matter no end there. Other names wey don enter EFCC radar na:

– Tunde Bakare, current MD of Warri Refinery

– Ahmed Dikko, former MD of Port Harcourt Refinery

– Ibrahim Onoja, another ex-MD of Port Harcourt Refinery

 

This whole gbege start after Senate Committee on Public Accounts, wey Senator Aliyu Wadada chair, raise alarm last week say di financial books of NNPCL from 2017 to 2023 get serious discrepancies.

 

According to the committee, the audited reports show irregularities wey reach over ₦210 trillion — dem call am “mind-boggling and worrisome.”

 

As EFCC dey dig deeper, Nigerians dey wait to see if justice go truly catch those wey chop refinery money while fuel dey scarce and refineries still dey sleep.

Write a Comment