Drama: Kano Man Climb Billboard, Say E No Go Come Down Unless TikTok Celebs Show Face

One kind strange drama shelle on Monday for Gadar Lado, along Zaria Road for Kano, as one man climb one big billboard and talk say he no go come down unless some TikTok celebrities wey he dey follow come see am face to face.
Di matter cause big commotion as plenty people gather dey look, some dey record with their phone. Traffick jam full di area as cars and okadas slow down to observe wetin dey happen.
According to Leadership News, the Kano State Police Command confirm di incident through their spokesperson wey write for him Facebook page say dem dey try rescue di man.
“Security operatives are currently trying to rescue him. He said that if the celebrities he follows on TikTok do not show up, he will jump. May God protect us,” the spokesperson post.
People wey gather for di scene say di man dey shout from top of di billboard, dey mention names of TikTok stars, beg make dem come meet am. He even talk say if dem no show, he go jump down.
As at di time of dis report, nobody sabi who di man be or wetin really push am to do wetin he do. Some people for social media dey talk say e fit be say di man dey go through mental wahala, while others blame social media craze and fame chasing.
Authorities never talk whether na cry for help, attention-seeking, or real mental health issue. But police and emergency teams still dey ground dey try calm di man down and avoid anything wey fit lead to tragedy.
Di event don open fresh talk on how social media dey affect people behavior — especially young ones wey dey chase clout or validation online.
Government and emergency agencies don beg public make dem no gather for di place again so rescue team go fit do their work well without crowd wahala.
As e be, rescue still dey ongoing and hope dey say di man go come down safely and get di help wey he need.
Write a Comment