Court Don Remand Man for Beating Him Wife Brutally for Ijebu-Ode, Case Adjourned Till October
One Magistrate Court for Ijebu-Ode, Ogun State, don order say make 57-year-old sawmiller, Fatai Quadri, remain for prison after one video wey show how e beat him wife like animal go viral online.
Di serious beating happen on September 15, 2025, for their house wey dey Illese-Ijebu, and people begin shout online after dem see video wey show Quadri dey use him hand and stick dey beat 50-year-old Rukayat Quadri like say na fight.
The woman suffer plenty injuries and dem rush am go hospital.
Di man appear for court on Monday before Magistrate P.O. Odunsi, and dem slam am with many charges like:
• Assault
• Domestic violence
• Breach of public peace
• Intimidation
According to wetin dey inside di charge sheet, Quadri even threaten say he go kill him wife because of quarrel wey start over a 10-room apartment wey he reportedly give another woman.
Di prosecution talk say everything wey Quadri do break Ogun State Criminal Code and also go against di Violence Against Persons Prohibition (VAPP) Law.
Di magistrate come adjourn di case go October 17, 2025, when dem go hear whether dem fit grant am bail or not. Until then, Quadri go remain inside correctional centre.
Ogun State Police Command don confirm say dem arrest di man sharp-sharp after di video go viral. Police spokesperson Omolola Odutola talk say di wahala start from accusation of infidelity.
She add say Rukayat dey hospital now dey collect treatment and police investigation still dey ongoing.
Ogun State Commissioner of Police, Lanre Ogunlowo, talk say di command no go allow domestic violence in any form, and anybody wey try am go face full law.
Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwasina Ogungbade (SAN), call di beating “very reprehensible”, and e promise say di state go carry di case well, make sure justice show face.
Also, Commissioner for Women Affairs, Adijat Adeleye, talk say government go support di woman, and dem no go rest until justice happe


Write a Comment