Bauchi Deputy Gov Break Silence: “I No Slap Tinubu Minister

Deputy Governor of Bauchi State, Muhammad Auwal Jatau, don finally open mouth talk after tori fly say e slap Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar, for turbaning ceremony.
Di gbege bin happen inside white coaster bus wey dey carry big men from Sir Abubakar Tafawa Balewa Airport go Emir Palace for Bauchi, for di turbaning of former Gov Mohammed Abubakar. Tori wey spread be say Minister Tuggar talk anyhow about Governor Bala Mohammed, and na im vex Jatau, wey con allegedly give am hot slap — right in front of Vice President Kashim Shettima and other dignitaries.
But Jatau media aide, Muslim Lawal, don deny di matter sharp-sharp.
“Haba! How Deputy Governor go slap Minister? E no happen at all. My Oga na responsible person, and no be person wey dey misbehave like that,” Lawal talk.
E even challenge anybody wey get video or any correct evidence make dem bring am come out.
“Where una see di slap? Who record am? Na from una I even dey hear this gist. For Bauchi? For inside bus? I no believe say such go fit happen.”
Wetin con make matter scatter more na say di Governor pikin, Shamsudeen Bala Mohammed, begin repost posts for Facebook dey hail Jatau for allegedly defending him papa. One post talk say:
“First Deputy Governor to slap Minister in Bauchi. Mr. Taka kasha mari.”
Another one talk for Hausa:
“Yau deputy govna ya jadada loyaltyn sa wa baba Kaura,”
Wey mean say, “Today, Deputy Governor show him loyalty to Baba Kaura.”
And e still repost this:
“Idan zai zagi Kaura sau Goma, Jatau zai masa mari sau goma kyawawa..!”
— Meaning: “If he insult Kaura 10 times, Jatau go give am 10 correct slaps.”
This whole drama dey come as wahala still dey between Governor Bala Mohammed and Minister Tuggar. Di two don dey drag since 2023 after di EndBadGovernance protest, and Tuggar — wey be Tinubu person and dey eye 2027 governorship seat — don accuse Bala of bad leadership and political packaging.
Write a Comment