55-Year-Old Man Run Away With Him Pikin Fiancée, Carry Family Money & Gold Join

One 55-year-old man wey get six children for northern India don shock everybody as e run comot with him own pikin fiancée, wey be 22 years old.
According to report from NTDV, di man wey him name na Shakeel, also carry di family savings — over $2,400 plus gold jewellery — as e take waka with di girl.
Shakeel, wey come from Rampur village for Uttar Pradesh state, don scatter him family after e disappear with Ayesha, di young woman wey supposed marry him son, Aman.
Shakeel wife, Shabbana, talk say na him force di marriage plan for Aman and Ayesha, even when she dey complain say dem no ready financially and di boy too young. But di man no gree, until one day e call dem from Delhi to confess say e don run away with Ayesha.
Shabbana talk say, “Di girl wey suppose be my daughter-in-law wan turn my husband wife.”
Report talk say Shakeel dey always visit Ayesha in the name of wedding plan, but di wife say she don dey suspect dem since. When she confront am, na so e begin beat her and even insult her. But she still gather proof.
Later, Aman see some love messages between him papa and Ayesha, come vex warn Shakeel say di marriage no go happen again.
Early dis July, Shakeel travel go Delhi for work, na from there e call house say e and Ayesha don elope. Wetin e no talk be say, he carry all di money and gold wey dey house.
Police tell Times of India say nobody don report formally, so dem no fit arrest Shakeel or take any legal action for now.
Write a Comment