45 Year Old Man Peme Inside Well For Ibadan

45 Year Old Man Peme Inside Well For Ibadan
45 Year Old Man Peme Inside Well For Ibadan

 

Oyo State Fire Service don talk say dem recover di body of one 45-year-old man wey fall inside well for First Women Estate, Akala area of Ibadan.

Di General Manager of di Fire Service, Mr. Yemi Akinyinka, confirm di tori for statement wey dem give news people for Ibadan on Sunday.

Akinyinka talk say dem receive distress call around 2:11 p.m. on Friday from one Mr. Yusuf say person don fall inside well. Firefighters rush go di place and see say di man dey trapped inside di well as e dey work beneath.

Dem later recover di man body and hand am over to e family. Amotekun Corps from Oluyole Command also show face come help.

Meanwhile, di Fire Service also respond to one fire outbreak for Salim Complex, Alafia Estate, Akobo, on Saturday.

Di General Manager talk say di fire start because of electricity surge and e affect one twin two-bedroom flat. Firefighters quickly quench di fire before e spread, and nobody die.

Akinyinka advise people make dem always switch off and unplug electrical appliances wey dem no dey use to avoid fire wahala.

Write a Comment