18-Year-Old Boy for Anambra Don Belle 10 Girls in 5 Months — Even Him Oga Pikin Join

18-Year-Old Boy for Anambra Don Belle 10 Girls in 5 Months — Even Him Oga Pikin Join
18-Year-Old Boy for Anambra Don Belle 10 Girls in 5 Months — Even Him Oga Pikin Join

 

One 18-year-old apprentice boy wey dem send go learn work for Anambra State don turn wahala, as e don allegedly put belle for 10 girls within just five months.

 

Among the girls wey him belle enter na him oga pikin and the salesgirl wey dey work for the shop. The matter don cause serious kasala for the area.

 

Dem talk say na only three months the boy don stay for him apprenticeship when e carry belle give both him master daughter and the sales assistant. As the matter burst, the boy oga no waste time — dem send am packing straight.

 

Anambra State Commissioner for Women and Social Welfare, Madam Ify Obinabo, yarn the matter during one live program for social media. She talk say she dey highly worried about wetin dey happen.

 

According to Madam Obinabo, after dem send the boy back to him village, the case even worse — e still go put belle for another eight girls within just two months.

 

She talk say:

“This boy dem send am go learn trade when e be 18 years. After three months, e don belle him master pikin and the salesgirl. Dem send am back house. Within another two months, e don give belle to eight more girls for him village.”

 

The boy mama even run go the commissioner office go find help. Madam Obinabo talk say the woman cry say:

“Anytime I see girl dey waka near our house, I dey fear say another one don carry belle again.”

Write a Comment