
Nature don contribute pursue one Oyinbo -Nigerian player commot for the camp of the National U. 17 wey dey for Abuja.
The player Iffy Udanoh wey him age be 16 years, and him height na 6-feet-4-inches na central defender for Aston Villa, but the beard beard wey him carry like Super Eagles players no sweet the Coaches wey tell am say make him commot am.
The player wey we hear say na NFF second Vice president Shehu Dikko recommend am, no gree commot the beard beard. The Officials wey no happy with the central defender, wey him real age na 16-year-old as dem born am for United States, come tellam say make him pack him kaya, return where him come from.
Some officials of the team, tell us say no bi say na the beard beard cause am wey dem take commot the tokumbo player, but because him no good reach those wey dey the team.