
Federal Capital Territory, FCT Don finally get one team for the Nigeria Professional Football League (NPFL).
One of two teams wey top their groups na him go fly the FCT flag for the Premiership League next season. Last Saturday, Nigerian Air Force FC and Road Safety FC qualify for the 2019 Nigeria National League play off. NAF FC finished top for their group A1 with 15 points after wey dem play 8 matches, while Road Safety finished top for their own A3 with 18 points after wey dem play 8 matches. The two teams go meet each other to pick one Oga, while the people wey finish for A2 and A4 go meet to find one Oga. The two of them go join the two wey come from B groups to play Super 4.
In a statement of Congratulate wey the Secretary of the FCT FA, Mr Haruna Usman Ilerika sign, him thank Nasarawa state Football Association and supporters of the two teams wey dey FCT and Nasarawa state.
Ilerika say the two teams dey FCT, but, Road Safety played their league matches for Snake farm, Keffi and na Nasarawa state FA dey handle am while NAF FC played their own for Area 3 playing ground.
The Board of FCT FA promised say dem go continue to provide dem conducive environment wey dem go take dey excel.