Home » News » Nigerian Troops don scatter Terrorists camp, rescue some Women

Nigerian Troops don scatter Terrorists camp, rescue some Women

Troops

Nigerian Army talk talk person Col Sagir Musa don yan say troops of 112 Task Force Battalion wey dey for clearance operations don join body with Civilian Joint Task Force, don kpai more members of the Boko Haram/ISWAP Terrorists, when the troops show face for the new camp wey dem recently established for Kajeri village on Tuesday the 18th of June 2019.

When the troops torchlight the place well well, dem come see some dangerous items like ;
a. 2 Dane Guns
b. 8 Cartridges
c 2 Torch lights and
d. 1 Bicycle.

The troops come rescue 2 Women and 3 Children wey dem suspect say na kidnap dem kidnap dem. Na for bushes wey dey Kajeri and Saleri villages dem see dem. Dem go carry the rescued women and children give the appropriate agency wey go take care of them.

The troops burn down the camps come continue their waka to clear everywhere wey dey around Kajeri and Saleri axis.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

*

x

Check Also

Hospital facilitates birth of Quintuplets In Awka

By Ikenna Nwokedi History was once again made on Wednesday, 29th March 2023 as Life ...