Home » News » Nigerian Troops don rescue some women and children from Boko boys

Nigerian Troops don rescue some women and children from Boko boys

Troops

Troops from 121 Battalion with some village hunters don rescue two women and six Children from some Boko boys wey dey pick race.

The rescue hapin on Monday, the 10th of June 2019 when the troops and the hunters dem lay siege for bush dey wait for the Boko boys wey dey run away for Gwadala village wey dey North Eastern part of Borno State.

When the gbege sele, the troops kpai one of the terrorists, others pick race with gunshot wujor. Some beta ammunition wey they recover from them include

1 AK 47 Rifle, 1 Dane Gun, locally fabricated Ammo and Projectiles

The Nigerian Army say the projections wey dem take dey do the ambushes, clearance operations and fighting patrols na part of the efforts wey the troops of 7 Division Nigerian Army dey do to consolidate for the gains and successes wey dem do record for the ongoing operation “Halaka Dodo” to make sure say dem commot the remnants of the BHTs make lasting peace and security dey the whole of North East.

The Oga for 7 Division Nigerian Army and Commander Sector 1 Operation Lafiya Dole, Brigadier General Abdulmalik Bulama Biu clap hand give the gallant troops wey do the job. Him come deliver the message of the Oga patapata of ndi Army Lieutenant General Tukur Yusufu Buratai wey commended the troops for the successes wey dem don record so far for the fight against Boko boys.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

*

x

Check Also

Peculiar Football Academy

Peculiar Football academy was founded In mid August of 2016; Since from onset, it has ...