Home » News » NAF don kpai 20 ogbogidi people for Zamfara

NAF don kpai 20 ogbogidi people for Zamfara

NAF

Nigerian Air force talk talk person, Ibikunle Daramola don talk say the Air Component of Operation HADARIN DAJI don kpai no fewer than 20 ogbogidi people for one location wey near Munhaye for Zamfara State.

Him talk say they carry out the operation based on credible intelligence reports wey show say some ogbogidi people don gather for meeting, wey dem dey plan to attack innocent civilians wey dey the communities.

Him say the Air Component use a Nigerian Air Force (NAF) Alpha Jet come attack the location, wey dey about 15 kilometres from the boarder with Katsina State.

When the Jet arrived overhead the area, the Alpha Jet see over 30 ogbogidi people wey dey attempt to run away from the place, while dem dey fire at the approaching attack aircraft. The Alpha Jet come bombarded them come kpai 20 of them.

NAF say dey go continue to collabo with other security agencies, to flush commot the ogbogidi people for Northwest part of the Country.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

*

x

Check Also

El-Rio Property Holdings Supports Paul E Cup

The organizers of the Paul E U17 Cup has announced that a Texas, USA based ...