
Make una stay una lane jejely leave our promising goalkeeper Prince Adegoke’s alone, na the thing wey London giants Chelsea tell NFF when they write letter dey request for the school boy goalkeeper make him come contest for Jersey for the Golden Eaglets team wey want go FIFA U17 World Cup for Brazil.
According to wetin allnigeriasoccer.com find out, NFF don write Chelsea through a letter dated 27th August 2019 with reference number NFF/GEN/TECH/204/VOL. IV, dey beg the London team make dem release of Adegoke for the Nigeria National U17 Men’s Team.
The English Premier League side come tell dem say dem no get plans to release the goalkeeper, say na waste of time, say the boy dey go school, and playing for Chelsea would be more beneficial than playing for Nigeria.
Our ear wey dey ground gathered say Chelsea never forgive NFF and U. 17 Coaches since wey dem carry Adrian Akande go U17 AFCON but the winger siddon for bench, wey him leg no enter field for all the five matches played in Tanzania.