Home » Sports » Double Wahala For CAF; As Esperance Fariga to return trophy and medals

Double Wahala For CAF; As Esperance Fariga to return trophy and medals

Esperance Sportive De Tunis don fariga say dem no fit replay the CAF Champions League Final wey dem don carry the trophy go home.

We go remember say; gbege happen few days ago when Wadad from Morocco waka commot for field say dem no dey play again afta when dey discover say ojoro dey for the final. Dem tell referee say make him go watch TV, referee say TV no good. Na him the Morocco team, pack their kaya and kayaes commot for field say dem no dey play again.

Na so CAF carry the trophy give Esperance, give them medals also, tell dem say na them win. Esperance return home go do Tanx giving. Only last week, the Ogas wey dey CAF come meet, come do about turn, tell Esperance say dem give them four days make dem return the trophy and medals.

As things stand now, Esperance don tell CAF say, this trophy and medals wey dem don go do thanks giving on top, dem no fit return am. They say dem no play again. Say dem don win the trophy, and don take the medals, wey the officials give them go ahead as champions. Say because VAR no work no bi there toro. Say na duty of CAF to find out if their equipment dey work or not.

Na him Esperance come take hand hit chest say If CAF or FIFA get problem with their final decision, make them play their own Final with the referees and VAR.

One comment

  1. Nice report

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

*

x

Check Also

NPFL 2023 : Abia Warriors Beat Rangers Again