- Amaju don step inn
Katakata wey dey hapin for Delta State FA because of election, don wear another cloth, as the Oga patapata for the Nigeria Football Federation, Mr. Amaju Pinnick don tell them say make them commot gorrila hand for the soup before e become human being hand.
Delta state Football Association, DFA, election wey suppose to hold on Thursday 13th, June 2019 for Best Western hotel, will now hold after the Nations Cup.
One tatafo person wey no wan make dem hear him voice, tell Tory people say the NFF Oga give order say make him people for Glass House set up panel wey go look into wetin dey hapin for Delta state football body. We go remember say na Amaju be Chairmo for Delta FA before him hand over to former Super Eagles Captain Austin Okocha, who leave the position take AWOL.
As e bi so, the Chairmo wey dey look afta the Delta FA since Okocha take off, Edema Fuludu say him no dey aware of the NFF decision. He advised all those wey dey contest say the date never change.
Sam Sodje wey wan contest Chairmo before, don wash him hand commot say him no dey interested again. He come wish everybody wey dey contest well.
16 persons na dem dey contest the election for Delta FA. They include:
1.Chief Tonobok Okowa-Chairman
2.Mr.EdemaFuludu –Chairman
3.Mr.StevenCole —V.Chairman
4.Mr.VictorIkpeba —V.Chairman
5.Mr.Ambakederemo Neville-Member.
6.Mr.Nwamuocha Kenneth-Member
7.Mr.Egho Dave. ———–Member
8.Mr.JuliusAtete. ———-Member
9.Mrs.Mercy Awhana–Member
10.Mrs.Ejiro Babafemi.— Member
11.Comr.Sheriff Mulade –Member
12.Mr Chukwuma Ochonogor–Member.
13.Mr Julius Ijeh. -Member
14.Mrs. Emubose Akpene.—Member
15.Mr.Azuka Chiemeka -Member.
16.Mr.Clarkson Ogo -Member.