Results of Aiteo Cup 2019 matches wey dem play on Wednesday show say many ogbonge teams like defending champions Rangers International of Enugu, Enyimba International of Aba, Nasarawa United, Katsina United, Sunshine Stars, Akwa Utd don waka commot for the tournament.

Smart City FC of Lagos, outsmart NPFL champions Enyimba International of Aba three goals to two. Lobi Stars Football Club revenge on top Enugu Rangers body, when they give dem two nil. Ambassador of Kaduna collect one zero for Warri Wolves hand.
Na only one zero e take EFCC of Abuja to kolobi Sunshine Stars Football Club of Akure, while Abia Warriors use jejely and wayoly waka pass the gate of Gateway of Abeokuta. Na two goals the Warriors wey come from Umuahia shoot pass the gate. For Makurdi, Aklosendi use one zero pass their brothers Nasarawa United. Akwa United no believe wetin dey see for the hands of Rivers United. Three goals na him United wire inside Akwa net.
Shooting Stars repeat wetin dey do Katsina United for 1995, wen dey beat dem two quondo for final. Na the same number of goals Sooting take pass Katsina for Abuja on Wednesday. Beta thing be say, the man wey score the two goals for 1995, Edith Agoye, na him dey Coach the 3SC team now.
Bendel Insurance no fit insure Ekiti United na four goals to two dey take waka pass them after full time ended goalless. Na the same penalty Kwara United take beat Crown of Ogbomosho five goals to four for penalty. The full match ended 1-1. Also, na penalty Cynosure of Abakaliki take beat Delta Force 11-10, Calabar Rovers also beat Wikki Tourists for penalties four goals to two. Niger Tornadoes commot Gombe United by one goal to nil.