
All the hope wey Super Eagles of Nigeria give their country men and women say dem go win the AFCON title for the fourth time, do scatter like ripe paw paw. Na only one ogbonge free kick wey Mahrez’s play for dying minute na him scatter the dream.
The game dey 1-1 when that free-kick wey Riyad Mahrez play just waka pass the Eagles defense, beat goalkeeper, come enter net yakata. Na so Algeria take win 2-1 come enter to play final for the 2019 edition of the Africa Cup of Nations AFCON. Them go play Senegal for final.
Algeria score their goal for 40th minutes when one beta pass wey Mahrez give from the right, hit Troost-Ekong for belle come fly enter net 1-0 . But penalty wey Odion Ighalo play for second half, na him return the fighting spirit wey dey Eagles body wey make them begin dey fight for the victory.
Algeria get small small chances when ball don dey finish, but them no use am until that last minutes powerful free kick wey Mahrez play, send them enter final of the 32nd AFCON edition. Them go play Senegal on Friday to know who go be champion, while Super Eagles go battle for the third place with another North Africa giant Tunisia wey Senegal also commot with one own goal.