Home » Sports » AFCON 2016: Eagles don land for Round of 16

AFCON 2016: Eagles don land for Round of 16

Na only draw, Super Eagles go need to top their group and enter the Round of 16 for AFCON tournament wey dey go on for Egypt. That match go be their last group against Madagascar on Sunday.

Super Eagles on Wednesday become the first country wey qualify for the knockout rounds for the 32nd Africa Cup of Nations finals. Na defender Kenneth Omeruo sama the ball better head from corner kick wey Moses Simon play. That goal give Eagles all three points

Odion Ighalo, who score against Burundi the last time, come be like say him forget him scoring boot for house against Guinea. Many times, him get opportunity to win the game for Nigeria, but the boot wey him wear, no answer am.

When game start, Syli Nationale dey do gira gira, but dem no no say, no bi person wey call police, dey win case. Before you know wetin dey happen, dem don fire three beta shots on target including one wey rattled Daniel Akpeyi, before Moses Simon fire over the bar when he free like cripple leg.

If Eagles win on Sunday against Madagascar, dem no go commot for Alexandra. Dem go play their round of 16 match there.


Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

*

x

Check Also

Super Falcons Will Excel At The 2023 Women World Cup… Gusau

President of Nigeria Football Federation, Alhaji Ibrahim Musa Gusau is full of confidence that the ...